YouTube star Darren Watkins Jr dey tour Africa, who be IShowSpeed? – BBC News Pidgin

youtube-star-darren-watkins-jr-dey-tour-africa,-who-be-ishowspeed?-–-bbc-news-pidgin

YouTube star Darren Watkins Jr dey tour Africa, who be IShowSpeed? – BBC News Pidgin

Wia dis foto come from, TOYIN ADEDOKUN / AFP via Getty Images Author, Penny Dale 26 January 2026 Read am in 6 mins One of di world popular content creators don attract plenty crowd, mostly im young fans, as im undertake 20-nation tour for Africa, e tok say di continent dey “full of surprises”. Pre-teen boys for Rwanda and Ethiopia cry wit joy and excitement as dem hug dia online hero for real life – wey dem sabi as IShowSpeed or just Speed, wey don get ova 48 million YouTube subscribers. Him dey famous for im high-tempo, frenetic and completely unscripted broadcasts wey fit last from three to 11 hours. African Americans don dey moved as dem see di love and respect wey dem show to dia countryman, wey go soon turn 21 during im “Speed Does Africa” tour. For Eswatini, dem give am di name “Logijimako” – wey mean “di one wey dey run” – during di initiation ceremony for royal palace to make am become warrior so e go fit protect di king and im family. Odas ontop social media don name am “Speedani”. Speed, wey im real name na Darren Watkins Jr, get surprised by di reaction
Read More

Exit mobile version